Cobhams Asuquo – The Traffic Song Lyrics
This Traffic sef
Na which day e wan end
Dear Lord, dear Lord
Deliver man
Like play like play
Na one day we don spend
Dear Lord, dear Lord
Deliver man
I don buy socks and water
For hold up o
Person don come wash my car
For money
Dem say na port hole
Wey dey one side o
Dear Lord dear Lord
Deliver man
Oh-oh oh-oh
Dear Lord dear lord
Deliver man
Bambi ala e don beg me taya
Dear Lord, dear Lord
Deliver man
See that Mopol
He wan burst my tyre
Dear Lord, dear Lord
Deliver man
Some say na senator dey pass
E block road o
Some say na pastor dey fight
With police
Me I no wan know
I just wan reach house o
Dear Lord, dear lord
Deliver man
Oo oo ooo
Dear Lord dear lord
Deliver man
E get one babe
Wey dey wait me for house
Dear Lord dear Lord
Deliver man
She say na me
Wey go tear her new blouse
Dear Lord dear Lord
Deliver man
I drink concoction for this occasion o
My baby please
Do not start without me
See I don dey drive
Like a mad man now o
Dear Lord dear lord
Deliver man
Oo oo oo
Dear Lord dear lord
Deliver man
E get person
Wey must reach hospital
Dear Lord dear Lord
Deliver am
Only God fit save Lastma official
Dear Lord dear Lord
Deliver am
Lastma direct korope near my motor o
The korope come bash my car
For traffic
Na who go pay for my headlights now o
Dear Lord dear lord
Deliver man
Oh oh
Dear Lord dear lord
Deliver man
This traffic sef
Na which day e wan end
Dear lord dear lord
Deliver man
Comment